The Minister of Information and Culture, Lai Mohammed don talk say odidi no dey hold the Federal Government becos of d demand wen United Kingdom lawmakers for dem to face sanction.
On Monday, the UK lawmakers debate about d alleged human rights abuses during the #EndSARS protest for Naija den dem come ask for sanctions on government officials and security agents like visa ban, freezing of assets, and stopping the funding and training for the Nigeria Police Force.
Wen Mohammed come dey react to the development during one televison chat today, he come warn foreign countries say make dem no dey take decisions based on “fake news”.