+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Stop To Send Tomatoes To Lagos – Tomatoes National Chairman

Di association wey dey in charge of supplying and selling tomatoes say as mata dey be for dem eye, dem go stop to send tomatoes from North go Lagos if govimet nor tok well about di issue.

On Wednesday nite wey be May 1, nai gbege hapun for ile-epo market for Alimosho, Lagos State afta one Yoruba guy win 60k bet from one oda Hausa betting shop, but di bet shop owner say make di winner show am love from di moni.

Di winner say na from he mind he go decide weda to pay or not, Oga bet shop say he nor go give moni. Naso fight start bifor you know jaguda boys don put fire for where di aboki take run go hide.

As di fire don burn tins for di market reach ground unto say di jaguda boys nor even allow police to enta or even fire service to quech di fire, di Tomatoes Crates Dealers Association of Nigeria wey say dem lost over 60,000 crates wey dem take dey store tomatoes.

According to di National chairman, Alhaji Ahmed Alaramma wey be still di National Seketary of Almagamated Union of Foodstuffs and Cattle Dealers for Nigeria, dey vex say say na rent dem dey rent all those crate give pipo wey dey sell tomatoes, and one of di crate na 6k dem use take dey produce am.

Wey hin dey follow tori pipo dey yarn on Sunday for Zaria nai di chairman take say na cus di raffia wey dem use take dey karey tomatoes dey spoil di tomatoes quick nai make over 70 of dem member dey rent di plastic crate and di Lagos market pipo suppose return am bifor jaguda boys don go burn all of dem.

He say na dem lawyer nai go take up di mata cus di total of wetin dem lost na 360 million naira, but if federal govimet or Lagos state govimet nor tok well then di state nor go see any product from North again.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM