+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Shoot Women Wey Dey Protest For Ughelli

Protest wet women for inside Oteri-Ughelli dey do say dem nor like di way police take dey kolet moni from dem hand, don turn anoda story.

Di women match go di area command office to take tok as e dey be Dem, bifor dem know police don dey troway teargas for dem, come even shot one of di women for leg, then beat shege komot from di others.

Wey Hon. Efe Erakpofoke Peter, di President General of di Community dey tok to tori pipo for inside hospital, he say na very bad tin di police dem do cus di women just wan go karey di mata tell di king of Ughelli kingdom wetin di area command dey do dem.

He say di area commander call am make he tok to he pipo make dem go back say he go settle di mata, but bifor di president general go turn, police don already dey shoot troway teargas.

Peter say na cus di community nor dey fit enter dem community in Peace again without say police no sakpa dem kolet moni from okada and motor wey dey pass di road.

Even Harvest Ugbhwiako and Mrs. Vivian Aphiare wey rep di women wey dey protest say police arrest dem children wey dem send message and ask for 50k, 100k, and 200k to use bail dem.

ACP Adebayo don say dem dey look di mata and go punish any officer wey he hand dey inside di mata.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM