+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

5 Pesin Don Die As Building Fall For South Africa

E don pass 24 pipo wey officials inside South Africa say dem don bring out from one five storey building wey fall yester Monday.

Dem say plenti wound and five pesin nai don die bifor dem go fit rush dem reach hospital.

Na 75 workers nai dey work for di construction site wey dey for George City, Western Cape Province bifor di building fall and 50 pipo nai dey under.

As rescue team dey ground dey find to save dem Pipo, officials say dem don know di names of pipo wey still dey under the collapse building.

Dem son dey do investigation to know wetin make di building fall for inside di South Africa city wey dey close to water.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM