+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Lover Kill Sugar Mommy Cus Of 100k

One guy wey dem call Akpoveta School don go kill him sugar mommy, Glory Akpaku wey all of dem dey stay for Warri cus of quarel over moni.

Wetin hapun be say, as dem dey waka for di relationship nai Akpaku tell Akpoveta say e go make sense make hin dey save moni and she fit dey epp am.

Na so lover boy start come save reach 100k, wey he come tell sugar mommy to give am moni she tok say she wan karey am go market fess.

As di boyfriend see say di woman no wan gree, nai he say he go tell her son, but Akpaku say if he try am make he know say di 100k don already waka.

Nai sugar moni say make boyfriend escort her to market, na road wey dem take dey go nai Akpoveta take knife shook di woman neck, hand and belle.

According to wetin di PPRO of Delta State tok, DSP Bright Edafe, di guy say na devil nai push am make dem forgive am.

Di mata still dey pass thru investigation and afta dem finish na court Akpoveta go see hinsef.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM