+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Politician Dey Tiff To Epp Pipo Life, Senator Ali Ndume

Di death penalty wey Senate dem pass against any bodi wey dem catch dey sell or smuggle drug dey make many pesin say e nor suppose be so as di punishment too strong.

Nai dem come dey ask Chief Whip of Senate, Senator Ali Ndume say why dem never give politician that kind punishment.

Nai Senator say di resin wey make politician corrupt na cus of di pipo but dat one nor mean say hin support say make dem give death sentence to politicians wey tiff.

He say if di politician tiff govimet N1m or N1 billion dem nor go kill that one cus he tiff too to epp pipo but di one wey tiff trillions of govimet moni nai suppose die.

Senator say na cus if politician tiff he go share di moni with pipo to save lives so that dem fit support am for di next four years for position.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM