+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Dem Kukuma Stop HND – FCSC Chairman

Di way pipo take dey use low eye look pipo wey finish from Polytechnics say dem nor reach di class of those wey go University don make di Chairman of the Federal Civil Service Commission, Prof. Tunji Olaopa, say make dem delete HND from di kontri.

Dis one na afta di Executive Seke of National Board for Technical Education, Prof. Idris Bugaje don join di shout say di way pipo dey treat HND graduate for di kontri nor just good.

Olaopa com dey say make dem go back to di Conference of Heads of Polytechnics and Colleges of Education tok for 2017 so that HND go get future for Nigeria.

Wey anoda man, Shammah Kpanja wey be di Academic Staff Union of Polytechnics dey tok for di one day meeting, he say he go beta make HND turn to BTech to to fit keep face high.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM