+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Hadi Sirika and Broda For Court Over Fraud Case

Di foma Aviation Minister Hadi Sirika join with him broda Ahmad Abubakar Sirika dey for court unto case wey Economic and Financial Crimes Commission, EFCC samakwe for dem head about fraud.

Na 10-count charge nai di Federal High Court for Abuja read to Abubakar Sirika, and na di owner of Enginos Nigeria Limited company wey dem give contract to do for di Nigeria Air.

While di court come say Hadi nor just try at all cus he use office wey dem give am take dey do anyhow, karey a whole N19.4 billion give Enginos Nigeria Limited, he junior broda company.

But as dem two hear di charge against dem nai dem reply say dem nor guilty.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM