+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Dey Tok To Mali, Niger, Burkina Faso To Come Back – ECOWAS

Mali, Burkina Faso and Niger Republic wey komot from ECOWAS go soon come back to di bloc as we don dey deep tok with dem.

Na wetin parliament member of the ECOWAS, Senator Ali Ndume tok for Kano as dem dey do di ECOWAS Parliament Extraordinary session meeting.

Ndume say wetin dem wan do to make di teree kontri come back dey in motion as di bad blood wey dey ginger di wahala don drop finish and di kontris nor dey vex with West Africa again especially Nigeria.

Di senator say wetin di committee wey hin na part of dey get beta reply and e nor tay again all dis upandan go end.

Remember say Burkina Faso, Niger Republic and Mali say dem nor do with ECOWAS again afta dem get punishment for allowing military to take over di govimet from  each of di kontri.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM