As Nigeria dey prepare to celebrate e years of democracy on di 29 of May 2024, dem say President Bola Tinubu wan go sitdon tok with House of Representatives members and Senators for one place on Wednesday.
Na di clerk of National Assembly, Sani Tambawal, nai tok so on Tuesday inside statement wey dem bring out on Tuesday.
President Tinubu go folow di National Assembly dey for their meeting and go still open di National Assembly Library that same tomorrow.
Na around 9 for morning nai di meeting go start and dem expect all senators and Honorable members make dem don sitdon dey wait for Presido.