+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Don Free Miyetti Allah President Afta Dem First Call Am Terrorist

Di charges wey Attorney General of the Federation, put for President of Miyetti Allah Kautal Kore, Bello Bodejo head say hin dey do terrorism act, dem don komot am.

For di court on Wednesday nai di counsel to AGF, Aderonke Imana take tell di court say dem use mouth take withdraw di case against Badejo base on interest of justice and to folow constitution.

As per say pipo wey bring case come court say dem nor want again, nai Justice Inyang Ekwo say Badejo don free to go.

Na few months back, na di Miyetti Allah President land for cell afta security go catch am say hin form vigilante group come give dem gun to take go fight.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM