+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Army Robber With Gun For Ekpan

Ekpan Police don catch and kill one arm robber wey dey disturb pipo for Uvwie and even dey kidnap some.

Wetin police tok be say dem bin go patrol along Army Barracks Link Road wet dey off Refinery Road for Ekpan, na there dem dey do stop and search wey one keke with teree passenger just sight dem nor gree stop, just start to dey run.

Naso police chase dem but na one nai hand touch and he confess say di others wey dey run na him gang member and na dem way to tiff pipo and sometimes dem dey even kidnap.

Police say dem see one local double barrel gun with live cartridges inside di black bag wey di guy karey, bifor di army robber come karey police go were dem take dey hide for NNPCL Link Road.

All in di name say he wan run as dem reach Ekpan bridge na there so suspect try to run, Jump enta di bridge but police rush karey am reach Ekpan General Hospital, na there dokitor confam say he don already die.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM