+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Woman don Vex Kill Yahoo Husband Cus Of Sharing Formula

One woman don go kill her husband wey she don born one pikin for cause of moni wey dem kolet from yahoo yahoo.

Oluchi Nzemechi, na 27 years woman wey from Ikeduru LGA inside Imo State, as police catch her nai she confess say na kitchen knife she karey take chuk her husband Kelechi Nzemachi bifor she knows he don already die.

She say na 2019 nai she take meet Kelechi and na dat time he introduce her to yahoo yahoo, even though say na she dey take care of wetin dem need, di husband dey always beat her.

Wetin come hapun wey make Kelechi die, na afta dem dupe one woman from Indonesian 250 million Rupiah but make dem share di moni well the husband come dey wan cheat her.

Na there Oluchi karey knife for kitchen take chuk di husband, as she see say he don die, nai she sharply karey biro and paper write say “You think say you for eat my moni run abei? I be baba for di boys. I go come for your wife and your pikin, plus your family pipo.”

Wetin di Imo Command Police Public Relations Officer, ASP Henry Okoye tok for statement be say dem don karey Oluchi go SCID for beta investigation and dem dey make way to return di 250 million Indonesian Rupiah to who get am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM