+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Abeg, I Nor Get Blending Plant For Malta — Mele Kyari

Di long problem wey dey between Aliko Dangote, owner of Dangote Refinery dey get different sides as day dey break.

For July 22 nai Dangote tell House Representative members say NNPCL and some oil traders don go open blending plant for Malta kontri near central Mediterranean Sea.

Dis oil blending plant na to re do condem motor oil wey dem don use bifor, clean am to remove di dirty, fuel and water wey dey inside, then dem go use am take do lubricants products.

But wetin Dangote tok di group chief executive officer (GCEO) of Nigeria National Petroleum Company (NNPC) Limited Oga, Mele Kyari on Tuesday say nor be true as him or any pesin wey dey work.wirh am nor get any kind tin like that outside Nigeria nor to tok of Malta.

Kyari for he X hakant take say he family pipo and friends dey ask am kwestun but as for am hin nor know of any bodi wey get that kind plant for Malta.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM