No be small cry pipo wey dey stay for Asa Umudim community for Osisioma LGA for Abia State cry afta one 40 years man go burn be haux cus of say di wife deg cheat on am.
Na God nai save di man say crowd nor kill am as dem hear say one of di pikin die inside di fire then di wife and two children dey fight for dem life for hospital.
According to di man, he say na tins wey fit make fire start nai he put for di haux bifor he set di haux for fire even with di wife and teree children inside.
Wey dem ask am which kind vex be dat, he say di wife get boyfriends cus she slnir dey ever leave her phone and dey always call day and nite.
Di Police Command for Abia don tok thru dem Police Public Relations Officer (PPRO), DSP Maureen Chinaka, say dem don start investigation on di mata.