+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Abia Man Cut Pikin Gbola, Kill Mama For Ritual

Anoda bad tin don hapun for again for Abia State inside It was a sad one for Umudosi community wey dey Obingwa Local Govimet as one Amadi Alozie wey dey ride keke go kill he mama cus she stop am make he nor cut he son John Thomas komot.

Wetin pipo tok be say na around 10 for nite nai dem di grandmama start to hear as he grand pikin dey shout. She come run go only to see say di papa don cut di grand pikin private part.

As di mama come dey try to rescue di small boy from di papa, naso di keke papa vex, karey cutlass finish he own mama bifor pipo rush come.

As di community pipo start to dey porchu Amadi nai he fall inside pit na there hand take touch am.

Right now di pikin dey battle weda to die or stay for hospital cus he gbola don komot.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM