Delta State University, Abraka, don suspend Ezi Ugoma wey dey for 200 level dey read Biotechnology cus she go video anoda girl wey dey die for di health center come post am foe TikTok.
Di skool say na bad tin nai Ugoma do so for that dem come first karey her to di Students Disciplinary Committee on di August 21, 22, and 25, na afta di meeting dem come judge her say she go against do oath wey she swear on matriculation day, therfore na four semesters she go stay haux.
Na di stool Assistant Registrar, Ughwumiakpor A. Nai sign di letter wey di Vice-Chancellor, Prof. Samuel O. Asagba, don already give go ahead to wetin di comittee tok, so from 2025/2026 academic session, Ugoma go dey haux till 2027/2028 session wey she go come return.
Many pesim say di treatment nor dey good as di resin wey make di girl do di video na to tell pipo make dem nor dey do abortion and now di stepfather don say na village nai she go take finish skool.
Even media pesin Rufai Oseni don send public beg to di Vice Chancellor make he think di decision again and epp di young girl make she nor just waste years like that.
