+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Afta Church Allnite University Student Kill Sef

Final year student of Adekunle Ajasin University, Akungba Akoko (AAUA) for Ondo State dem don see her deadi bodi ontop tree for back of her church.

Modupe Ayandare dey for 500 level for Department of Agronomy, on Sunday nai she komot hass go nite vigil for Onireason Street di side wey di off campus hostel dey.

But friends and neighbors come dey wonder why she nor come back till Monday wey dem see her body dey do jagoliva ontop tree.

Di Nigerian Association of Agricultural Students (NAAS), Alake Raphel say Ayandare na very quite girl wey pipo know as Comrade Modesty and e dey so painful say she kill hersef.

Even di Student Union, NAAS don dey beg security pipo to find out wetin make Ayandare go kill hersef.

Police spokeswoman of Ondo State, Funmilayo Odunlami-Omisanya,confam di case and say dem don start investigation into di mata.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM