+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Age Nor Suppose Be Skool Problem, Govimet Put Eye For Important Tin — NUT, ASUP

Too many plus and minus tok nai deg follow di la ban wey govimet say na only 18 years nai fit write WASSCE, NECO and JAMB from year 2025.

Prof. Tahir Mamman nai announce am on Sunday for TV, ASUU karey back am but Seketary general of NUT, Dr Mike Ene, and other pipo just dey provocate with di policy.

Ene come dey ask of children wey dem parents dey karey go KG class wey di pikin still small cause di papa and mama get hustle cus of how ecomomy be, and teachers nor fit leave di children not to learn cus brain ability na to dey work and function.

Naso he come say olden times, pesin go stretch hand reach ear if e nor reach nor skool. So if dem want make dis dem policy work make govimet start am from di foundation.

Even National President of Academic Staff Union of Polytechnics, ASUP, Shammah Kpanja, come dey ask what about children wey get gift and smart for class, di policy na just to wicked dem make dem stay over for skool.

Kpanja come dey advise govimet to make beta policy wey go favour everybodi cus nor be dis one be Nigeria problem right now.

He say make dem look north small pikin of 12 years fit marry born pikin dem never stop am na di age wey dey go skool nai come be problem for di kontri.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM