+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Akwa-Ibom Govimet Dey Find Two Dokitors Wey Japa Afta Dem Training

‎Akwa-Ibom govimet don karey vex follow two dokitors wey run leave dem duty post japa say dem must return back or pay di moni wey di state use take train dem.

‎Na di Commissioner for Health Dr. Ekem John, nai tok for press conference on Tuesday say instead of of di dokitors to work di nuba of years wey dem agree after di state don use moni train dem for 8 years, di dokitors abadon dem japa.

‎Di dokitors na consultant radiologist, Dr. Uduakabasi Ita, and consultant haematologist, Dr. Mfonobong Bassey wey dey under di state ministry of health.

‎D govimet don say weda na hole dem run enta dem go enta dat hope drag dem come outside so that dem go complete the years wey dem agree with di state of make dem kukuma return all di moni wey di state use take train dem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM