+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

All Awa Members Go Take Over LP Offices As Abure Nor Wan Hear Word — Joe Ajaero

National Seketary of Labour Party, Alhaji Umar Farouk say dem go soon put mouth for di threat wey Nigeria Labour Congress Leader, Joe Ajaero tok cus of say court don sack Labour Party National President, Julius Abure.

‎Wetin make Farouk tok so na cus of say Comrade Ajaero say he go tell all di union leaders wey dey di 36 states join hand plus di National Seketaria of LP for Abuja, to porchu Abure from di party.

‎Ajaero start all di plenty tok afta Supreme Court say make Abure karey he chair komot from di position as LP National Leader.

‎Na di tin come make Ajearo dey vex say even with wetin court tok, Abure and he team still dey karey demsef like leaders of di party but di National Seke say make pipo nor resin wetin Ajearo dey tok as na initial gragra dey worry am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM