+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

All Okada And Keke Riders Stop To Wear Face Mask — Sapele Council

Sapele Local Government don give new rules and regulations to all di Okada and Keke wey dey ride for di town say dem nor wan dey hear bad case as dis one go epp make everybodi dey okay.

‎Na on Tuesday nai Honorable Raymond Overah wey he di council seketray say dem don give only one month for all di keke and okada to follow di new rules of say dem nor go dey wear face mask again and okada go dey start by 6 for morning and close by 8 for nite while keke go start for 6 for morning then close by 10 for nite , say any bodi wey nor follow rule na arrest straight.

‎Di statement wey dem show tori pipo for Warri say any okada man wey nor wear traffic jacket wey dey shine and must carry di area code, matter nor go easy for am for keke dem must show dem VIO nuba for di keke and put beta cover wey rain dey fall and if passenger nor.see such make dem nor enta.

Di council say any keke or okada man wey nor follow wetin dem don set just dey fine trouble and go dance to di music. While for di ATP premises any union member, operators or even pipo wey dey stay around go tiff or nor follow di rule, na shoot on site be di command, so e beta make everyone take caution wey day still break.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM