Army troop of Operation HADIN KAI (OPHK) don arrest eight pipo join with 2 wey be di provider of bomb to suicide boming group.
Na Lieutenant Colonel Sani Uba, Media Information Officer of OPHK Joint Task Force nai tok so on monday say na with di epp of information dem take go arrest di bad pipo for where dem dey stay.
Wey Army reach di haux no be small tin dem see to moni, jewelries, phones, different ATM card and plenty oda tins.
Wey di suspects come reach army cell, one wey hand don bin touch identify di two suspects say na dem dey really bring materials wey dem take dey do bomb.
Investigation don start and some pipo wey dey stau di compound dem hand still join for di mata.
