+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Army Major Wey Dem Tiff For Bomadi, Dem Don See Am

Di Lt. Colonel Josiah wey kidnap tiff for Bomadi on Monday nite dem don see am for inside Tuomo forest.

‎Dem see am for di forest as di kidnapers tie am join canoe with he leg and hand wey dey bring blood from gunshot.

‎Naso di community pipo take rush am go one camp wey dey close bifor dem come call di Military Joint Task Force wey come karey di oga go hospital.

‎Remeber say we bin tell you say kidnaper go tiff di senior Army man on Monday nite for Bomadi wey he lodge afta he komot from marriage ceremony wey he attend for Kpakiama community.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM