+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

ASUU Dey Warm Up For Anoda Nationwide Strike

Na pure wickedness nai Presidency and National Assembly dey do cus na only dem belle nai dem dey resin, nor dey think of how even beta di ecomomy.

Dis na wetin lectures wey dey for University of Nigeria, Nsukka, Enugu State under di umbrella of Academic Staff Union of University, ASUU, dey shout wey Comrade Oyibo Eze, Chairman of ASUU-UNN, dey accuse govimet say dem nor folow di agreement of 2009.

ASUU chapter for UNN say as e be so be like skools go strike so that Federal Govimet go hear word cus that na di only language wey dem dey understand.

On Thursday naso di Union waka for di skool with different placard dey protest di hardship of how govimet dey behave towards dem.

Dem say dem don use diplomatic and political way e nor work cus govimet dey do one tin for front but dey tok anoda tin for back.

Comrade Eze even say President Bola Tinubu tok for campaign say he got end ASUU strike, but one year don reach dem still dey waka upadan for same tin.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM