Many pipo for North don dey shout say wetin dey hapun dem eye nor fit see dem nose as Bello Turji weh be very bad terrorist leader don force plenty pipo dey komot from dem villages with di new one of Tidibale community for Sokoto State.
Seketary of Sokoto Eastern Zone Development Association, Muazu Shamaki, confam say video wey.dey online dey show how motor overload with pipo property wey dey run from Tidibale na true but make govimet come epp cus na beta suffa dem don enta so.
Shamaki say e pass 20 settlements wey pipo don run comot but di villagers still get mind say security go come push di bandits back, make dem fit return home.
Na beg nai di pipo of Tidibale dey beg say make govimet come quick cus dem dey fear Bello Turji wey don porchu dem with odas from dem land.
