+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Attack Family For Abia State

On family from Avodim community, Ubakala, Umuahia Abia State enta fulani herdsmen hand but na only God save dem life that morning.

Wey Mrs Adaobi Ibegbu dey tok how e hapun, she say as dem wan enta di farm that morning, naso dem hear nosie for back only to see say na Fulani men with guns and cutlass.

Na di family use force enta inside lock di gate come run to.di end of di farm but one of di bandit jump di fence anoda one come enta dey ask for her husband.

Di woman say she nor know say di husband don run go look for epp but as di bandits dey ask dem come wan karey her son, say dem go kill dem.

Naso she push dem and as di fulani men see say di husband don run, nai dem drop di pikin use fence jump out.

With di epp of di husband wey run to call Vigilante naso dem take quick come save di family.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM