No be small pipo nai bandits kpai for teres villages wey dem use more than 41 okada take enta, burn haux and still tiff pipo ontop.
All dis kasala bust on Saturday morning wey di bandits first reach Tunga-Makeri bifor dem come enta Konkoso and Pissa villages. Police say na six pesin die for di first village then 20 come leggo for di oda two villages.
But wetin Musa Saidu di head of the State Emergency Management Agency (SEMA) for Niger State, tok be say na 29 pipo don kpuff and di nuba go still go up nore than do 29.
Police don send security team to di villages and dem don start to dey look for those wey bandits tiff.
