+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Dey Use Network From Anoda Kontri Take Post For Social Media — Daniel Bwala

Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop do resin wey make security agencies never catch those bandits wey dey spread moni for TikTok.

As pipo dey shout say terrorists dey kill, tiff pipo kolet moni and even dey show am for social media but govimet hand never still touch dem but if na ordinary pesin tok small tok for social media hand don touch am nai Bwala say make pipo nor dey resin am like that.

He say e nor easy for security pipo to just go catch di banidts cus dem nor dey use network provider wey dey Nigeria but from anoda kontri and to track dat kind dey very hard.

Di special adviser come give example of wetin dey hapun for Ukraine and Russia, say internet like star link wey dey use space, pesin nor fit trace am so all dis network wey di bandits and terrorists dey use, e nor dey register for Nigeria if not hand for don touch dem since.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM