+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Don Tiff 9 Uni Students For Kogi State.

Anoda strange tin hapun for Kogi State on Thursday nite as bandit enta university wey students dey read go tiff 9 of dem.

Wetin pesin wey see tok be say na around 9:00 for nite wey di students of Confluence University of Science and Technology (CUSTEC), Osara for Okene, dey read for dem exam wey go soon come nai bandits just bust out from nor where enta di hall.

Now di Govinor of Kogi State, Ahmed Ododo don tok for statement thru him Commissioner of Information, Kingsley Femi Fanwo, say dem don send security and hunter wey sabi di bush to enta find di students.

Di Govinor say he nor just hapoy with di bad news as dem hear say na from bush nai di bandits take jump enta di skool come dey shoot, enta different hall dey catch students wey dem karey go

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM