No be small bad tin bandits dem do on Sunday night for Barkin Ladi and Riyom local govimet for Plateau State, cus di nuba of pipo wey don kpai dem nor fit count am.
10 deadi bodi nai dem don see for di communities according to di community leader for Berom Youth Moulders Association, Rwang Tengwong.
He say two oda deadi bodi dem see an for Dorowa Babuje, while dem still shoot anoda pesin for Jol village inside Riyom local govimet council.
Sem say na around 7:27 for evening di bandits take land and teree pipo wound and det hospital. But di PPRO of Plateau, DSP Alfred Alabo, never tok on di mata.
