More than 30 pipo nai don kpai for di attack wey hapun for Kasuwan Daji market for Demo community, Borgu LGA of Niger State, on Saturday as plenty bandits enta di village tiff and born market.
Di bandits enta di village around 4 on Saturday evening, naso dem rob till sunday morning, dey shoot, tie pipo and kidnap plenty odas and nobodi fit stop dem.
Dem say na di National Park for Borgu LGA nai di terrorists take pass enta, karey out dem evil plan and with di way tins dey go pipo wey di bandits many cus dem still dey find many odas.
Niger State Police Command thru dem tokpesin, SP Wasiu Abiodun, confam di mata say dem don send epp there cus na around 9 on Sunday morning nai dem hear wetin bandits do for di village and dem don dey make way to free di kinap pipo.
