+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bifor 3 Months CNG Motor Go Full Kontri — FG

To make tins easy for Nigeria pipo, Federal Govimet don promise again say in the next teree months dem go full compressed natural gas station and moto for di kontri.

Na on Saturday for Lagos nai di Lagos State Project Director and Chief Executive Officer of Presidential Compressed Natural Gas Initiative, Michael Oluwagbemi take give di assurance again for di park to park CNG mobilization for Ojota park.

He say by that time dem go roll out 30,000 motor for distribution wey go cost dem N1.2 million for one motor and di total moni wey dem go use na N36 billion.

Stressing further, Oluwagbemi come still say dem go distribute am for di whole kontri and na to make pipo nor dey buy expensive fuel wey dey between N750h to 1k.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM