+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

‎Boat Tumble For DRC Kill Football Players

Some pipo don die for boat wey tumble for Kwa River wey dey Southwestern part of Democratic Republic of Congo on Monday.

‎According to di provincial tokpesin, Alexis Mputu, 25 persons nai don die and plenty of dem na boys wey go play ball for Mushie City wey dey Maï-Ndombe province and dey go back to den haux.

‎Dem say na cause everywhere dark and di boat driver nor dey see well nai make di boat tumble plus be like pipo too Kuch inside, cause boat accident dey hapun wella for DRC.

‎But di administrator wey dey did Mushie territory say 30 pipo survive for di boat and dem dey hospital for treatment.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM