+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Boy Tiff And Kill Namesake Afta Papa Not Pay Ransom

One 18 years boy, Obodoagu Ikediekpere Wisdom wey dey stay for Okinitor, Amankwo Ngwo for Udi Local Council, Enugu State don kill he cousin namesake wey be Obodoagu Wisdom and na just five years.

‎Na for August 11 nai police take catch di teenager then di pesin wey him follow plan, Sunday Micheal from Adamawa wey dey work as security guard for 9th Mile Corner, dem catch am on 12 of August afta dem don ask di pikin papa for ransom.

‎Di Command tokpesin, Daniel Ndukwe say dem tiff di small boy on July 26th, bifor di cousin wey mastermind everytin come go use Sunday take call di pikin papa to pay dem N1 million but di papa nor gree pay.

‎As di N1 million nor come out nai Obodoagu kill he own cousin wey be he namesake, then come bury am near one bush close to dem haux.

‎Wey police dey ask am kwestun na there he karey dem to di place wey he take bury di small boy wey don already die.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM