Wey Muslims dey celebrate Eid-el-Kabir some other pipo dey use am take get life beating.
Dat na wetin hapun to the local govimet chairman of Katcha inside Niger State, Danlamin Abdullahi Saku, as boys use beating take dash am as Sallah gift as he nor gree pay gbese wey he dey owe pesin.
Saku borrow N1.3m from one of hin friend and di tin don dey reach two years but he never gree one pay. When di friend ask am he go dey post am.
As Sallah dey nai di friend come send pipo to go kolet di moni, but chairman come use vex slap one of di boys.
Nai di boys go gang up come meet am later with enough gbasgbos and beating till chairman faint, bifor dem rush am to hospital where he dey take treatment now.