+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Burkina Faso Military Don Catch Nigeria Plane And Sojas For Bobo-Dioulasso

Afta presido don send military aircraft to go epp Benin Republic on Sunday after for di coup wey almost hapun for di kontri, 11 Nigerian sojas don swim enta Burkina Faso military hand on Monday nite.

Normally for Burkina na crime make any kind plane dey turn for dem airspace and dem must gun am down, so wey Nigerian airforce C-130 come do emergency landing for Bobo-Dioulasso nai di military catch di sojas, dey ask wetin dem dey find.

But one security analyst, Brant Grant, wey share di tori for X, say he suspect say di Nigerian Air Force C-130 plane dey go Senegal wey di tin take hapun.
He say he bin tik say na Tamale, Ghana, nai di plane bin wan go but only di transponder off by e sef or only di pilot off am cus of di emergency landing, and just dey go for up untill e land for Bobo-Dioulasso.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM