Di whole of Catholic church don turn celebration to cry on Easter Monday as dem hear news say Pope Francis don die for di age of 88 years.
Pope Francis wey be di first Latin American leader for Roman Catholic Church, don dey sick since for some time bifor news dey come say he don finally die.
N for di Vatican TV Channel nai one of dem bishop take announce am say di cold wey dey di Pope bodi don finally take he life around 7:45 today morning.
Di cry plenty for Catholic pipo eye cus many of dem see di Pope on Easter Sunday wey dem karey am drive for St. Peter’s Square but dem wake up to hear say dem Pope die.