+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Celebration As Whale Die For Brass Community Sea Shore

Pipo for Okpoama kingdom wey dey Brass Island, Brass LGA for Bayelsa State, dey do thanksgiving onto di big animal wey God send give dem for Okpoama beach.

Early mormor Wednesday for di seashore wey dey close to di Atlantic Ocean nai dem see very big whale wey don die, naso pipo start to run go go karey cutlass, knife anytin wey sharp to fit take cut portion of meat.

Di whale long reach 15 meters, 5 meters wide and 3 meters high nai youths of Twon-Brass, Odioma, Fish Town and Sangana surround with rubbers to take dem portion go hass.

One foma chairman of Nigeria Union o Journalists wey still come from di community An indigene of the community, Mr Tarinyo Akono, say e be like di whale lost road afta water low for am on Tuesday nite, but say if e bin still dey alive dem for push am back to di sea.

Di youth president for Okpoama Seiyefa Felix Ben-Basuo, confam say di way di fish big pipo still dey cut am for di water side.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM