+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Children Party Stampede: Oyo State Govimet Free Queen Naomi, Others

Di teree pesin wey dey face 18 count charges for Oyo State cus of di stampede wey hapun for December 2024 and kill more than 35 children, court don free dem

‎Di charges wey di state govimet for Oyo State put against Queen Naomi Silekunola, wey be di foma wife of Ooni of Ife; Alhaji Oriyomi Hamzat, owner of Agidigbo FM; and Abdullahi Fasasi, di principal of Islamic High School, Bashorun, Ibadan, were dem wan take do di children party bifor wahala come hapun nai dem don free so.

‎For di court session di teree pipo show face but start to dey smile afta di state govimet say dem nor want case again and all di charges against dem head don komot.

‎Afta do court case nai di Oyo State Attorney General, Abiodun Aikomo, come still confam di update for briefing say dem just get to follow di law process to makes sure say no bodi dey guilty of di blame wey make di children kpai.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM