+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Coach Finidi Don Tok Why He Resign As Super Eagles Coach

Super Eagles coach wey dem just appoint George Finidi son pack bag say he nor do again and tok why he nor want di position again.

Di 53 years coach say cus Nigerian Football Federation, NFF wan go get new pesin wey go dey adviser di team so e clear say dem nor want am again.

On Saturday nai Finidi drop letter give NFF afta he nor hear from dem afta dem do meeting finish on Wednesday.

One video wey di foma media officer of Eagles, Colin Udoh, come post for social media nai come dey open up on why Finidi stop di work.

Udoh say for di meeting wey dem do, dem nor tok anytin about technical adviser for Finidi to hear but afta di coach landed for Port Harcourt nai pesin call am to let am know.

Afta some days Finidi nor hear from di board nai e clear say dem nor want am again, so he get resign quickly.

Di foma Eagles resign dey come afta di 2-1 lost wey Super Eagles get with Benin Republic for di match wey dem dey prepare for 2026 World Cup.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM