Bong County Technical College, BCTC, wey dey for Liberia di Students don dey vex for James Saybay wey he di Vice President of di skool Administration cus dem see one of he naked video for social media.
Na from chat room nai di video first start to spreed to X bifor di tin enta everywhere for Bong County as dem se Saybay dey play with he John thomus for video call with one girl.
But di man don say di video na AI work as nor be him be that, say pipo wan just spoil he name and he go karey di pipo to court.
Even though say Saybay don say no be home dey di video no bodi beloved am and di students don change he name to weapon anywhere dem see am and dem say he must komot from di position.
Local leaders, including members of the Bong Legislative Caucus, Local leaders don start to use kona mouth tok but never come out openly.
Even do BCTC skool admin never bring any statement about di problem wey dey di skool now.