+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Community Boys For Kaduna Don Kpai Pastor Say Na Witch

One Pastor Dio Idon of the Evangelical Church Winning All (ECWA) man, Pastor Dio Idon wey dey for Ungwa Shaawa LC, Kasuwan Magani DCC of Kaduna State nai community boys don use beating kill cus dem say hin na witch.
Na di Theological Seminary, Kagoro, nai say di community launch attack for di pastor on Sunday January 4th cus afta he broda wey dey sick die, nai dem say na pastor kill am.

All di beg dem beg di boys nor work as dem say na pastor Idon kill di broda, dem use stone stick attack di pastor afta he die, dem come burn di bodi.

Di seminary wey pastor Idon finish from say wetin di community do nor make any sense and na wetin ear nor dey hear but pray make God touch dem heart to change.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM