+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Congo Get New Govimet Afta Many Months

Di govimet of Democratic Republic of Congo, DRC, don put Guy Kabombo Muadiamvita as di new minister just few days afta miliary wan take over di kontri.

Na on Wednesday nai dem make di announcement afta five months wey di kontri vote President Felix Tshisekedi for di second time ontop of all di many wahala wey di kontri dey face.

Remember say military scatter plan of some other military pipo join with outsiders wey put bodi to wan cause problem for di kontri.

Di coup pipoeven burn and scatter tins for Palais de la Nation wey dey close to where Tshisekedi office dey.

Bifor DRC dey put fis new govimet, dem don dey shift am go front for long since Tshisekedi enta office afta di election.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM