+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Council Don Announce Mahamat Déby As Chad New President

All di pipo wey put up for di May 6 election for Chad, don come out to congratulate Mahamat Déby as dem don call say na him win di election.

Di Constitutional Council on Thursday announce di whole result wey come make Prime Minister Succès Masra and foma Prime Minister, Albert Padacké rest.

Wetin di result from di National Election Management Agency show say na Masra na be second while Padacké come take third position.

Masra for hin own side don resin am say notin for am again, naso he take di result as he see am wey di Constitutional Council President, Jean-Bernard Padare, come laslas announce am.

Bifor dem announce di result, Masra don bin go dey announce for Facebook say na hin be di winner and make security, di kontri pipo stand with am to fight for di victory.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM