Social media influencer, Vincent Martin Otse known aka VeryDarkMan don land for court on Thursday cus of say he bad mouth pipo online.
Na for Federal High Court for Abuja nai VDM face Justice Musa Liman, for new five count charges wey he dey tok against singer and actress.
Dem say he bad mouth Tonto Dike, Iyabo Ojo, Samuel Oguachuba aka Samklef and oda pipo but VDM say he nor dey guilty.
Afta di court hear he tok nai dem karey di case fo July 24 to kwatinue.