+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Don Sack Ighodalo As PDP Candidate For Edo State

Federal High Court for Abuja don cancel di primary election wey bring Asue Ighodalo to be di Govinoship candidate of PDP for Edo State.

As Justice Inyang Ekwo dey deliver di jorjimet nai he take cancel Ighodalo position cus 378 members of delegate nor fit join vote for di February 22, 2024, primary election for Edo.

Justice Ekwo say di primary election wey dem do for Samuel Ogbemudia Stadium for Benin city, nor get enough fat and oil cus e Ven go against di provisions of 2022 electoral act and di guidelines of PDP.

Dis jorjimet dey come afta some delegate wey Kelvin Mohammed stand with karey petition go meet court cus dem nor happy with di way di election go.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM