Udu Court don sentence Alex Young Vweta Egone make he go chilax for prison for six years cus he dey waka upandan deceive pipo for Udu say hin an lawyer and dem even dey give am work to do.
On Tuesday nai police karey Egone reach Magistrate Court 1 for otor-Udu LGA na there dem samaram charges kg wayo and lie say hin na lawyer.
Na Udu Branch of Nigerian Bar Association, NBA, nai catch Egone on August 2, 2025, bifor dem come karey am give police, wey dem come go check he haux nor be small tin nai eye see as he gets different deed wey he don do for pipo and di ones wey he don write to some police command.
Di fake lawyer get ink, NBA stamp and seal wey be he name and Supreme Court nuba of anoda lawyer.
Wey dem tell am for court wetin he do, nai Egone say he dey guilty, na there court send am to cool off for Okere prison for six years.