+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Don Send Man To Prison Cus He Tear Small Girl For Osubi

Afta many months wey one man Ernest Okporu go use hin property take scatter 11 years girl for Osubi Community, court don las las decide hin case.

Na for March 2024, nai Ernest go use force tear di small pikin afta he tie her with rope, dem come report to poilice from there to court bifor di case come end on Thursday.

Di State High Court for Abraka, Ethiope-East come sentence Mr. Ernest to 12 years of prison and na Justice S.I Okeleke nai give di punishment.

Even one of di Senior Special Assistant to Govonor on Human Rights, Kelvin Ejumudo, come dey greet di court for di jorjimet as di small bodi still full with fear.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM