Naija daily count of coronavirus infections drop go e lowest for more than one month with 506 new cases wen dem confirm on Sunday.
The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say dem record the new cases for inside 20 states.
The last lowest daily count na on January 2, when dem confirm 576 samples wen dey positive for the virus.
Meanwhile, the 506 fresh cases don carry the total number go 139,748. Whereas na 20 people nia legoo within 24 hours, and dis one so come carry the number of deaths go 1,667.